Cobhams – Despite (We Rise Up) Ft. Qing Madi & Magnito (Lyrics)
Despite (We Rise Up) Song Lyrics By Cobhams Ft. Qing Madi & Magnito
Nigerian producer and singer, Cobhams Asuquo has released the lyrics to his new song “Despite (We Rise Up).” In this track, he works with Qing Madi, a gifted vocalist and Magnito, a masterful rapper from Nigeria.
The lyrics grab your attention from the very first line and keep you engaged until the end. Listen and sing along with the lyrics, and you’ll surely want to add it to your playlist to enjoy anytime you want something fresh and uplifting.
Despite (We Rise Up) Song Lyrics By Cobhams Ft. Qing Madi & Magnito Below.
(Anywhere you do mama sing o
Anywhere you do mama sing, mama sing o
Haliba halibali
Many me, many many
Onome pay the money)
Despite everything wey dey divide
Many many things still dey unite us
We get the power to decide
How we wan face who dey fight us
Despite everything wey we get
Some people still put us for debt
But dem don forget say
Dem no dey use lion do pet
Small pikin no dey forget
Who flog am im first cane
By the Grace of, by the Grace of, by the Grace
of God
Aje
Many things dey bother me but
Me I stay on course
Oshey
Ten toes for the leg work
Na to build legacy wey go big pass us
Dem never born wetin fit stop us
If dem push us down
We go still rise up
Despite all the hustle e go pay
One day e go still soft
Despite all the problem we dey face
We no go give up
We go put ten toes for the leg work
We go build legacy wey go big pass us
Dem never born wetin fit stop us
If dem put us down
We go still rise up
(We Go still rise up)
Many things wey full for my mind
As I dey hustle I dey grind
The matter cast say na die
Make water full for my eyes
I take the water make concrete
I step on it and I stand fit
Dem be dey pray make I stop
As I dey press play nobody fit pause me
By the Grace of, by the Grace of, by the Grace
of Jah
Aje
Everything go work for me
Everything go soft
Oshey
We go put ten toes for the leg work
Make a lot more zeroes for the networth
If they strike me down I go rise up
I’m the pain in their neck
I’m the virus (oh why)
Despite all the hustle e go pay
One day e go still soft
Despite all the problem we dey face
We no give up
We go put ten toes for the leg work
We go build legacy wey go big pass us
Dem never born wetin fit stop us
If dem put us down
We go still rise up
To build a school for a nation you go start with
classes
To perfect any skill you gats start with practise
My people are not smiling and that’s what the
fact is
Ask anybody around you can ask the masses
Nothing is adding up I’m telling you and proof
dey
For all these government office you go know
say crooks dey
How you go work one day start weekend on
Tuesday
We suppose get attendance make dem know
say rules dey
Ga shi nan duk yaran mu tor sun pita
A cikin kauye ai taburma mu ka shimpita
Su na kwashe kwashe ga jakan su ya cika
Sun kwa che kudin ko kolon mu za su rikita
We can be great again o we get the tendency
Dem go begin respect our passport for
embassy
We don start am already show dem make dem
see
We wan create Murtala Muhammed kinda
legacy
Despite all the hustle e go pay
One day e go still soft
Despite all the problem we dey face
We no give up
We go put ten toes for the leg work
We go build legacy wey go big pass us
Dem never born wetin fit stop us
If dem put us down
Ooooo we will rise up
We will rise up
We will fight for our freedom
We will rise up
We will fight them with wisdom
We will rise up
We will rise for our nation
We will rise up
Rise to the occasion hey
We will rise up
We will stand on our ten toes
We will rise up
If they ask us to bend over
We will rise up
We rise and say no
We will rise up oooo
Despite all the hustle e go pay
One day e go still soft
Despite all the problems wey we face
We no give up
We go put ten toes for the leg work
We go build legacy wey go big pass us
Dem never born wetin fit stop us
Even if dem shoot us down
We go still rise up
Do you find Tunesloaded useful? Click here to give us five stars rating!