Falz – Church Mind Ft. Priesst & Kurdi Klymax (Lyrics)

Church Mind Song Lyrics By Falz Ft. Priesst & Kurdi Klymax


Falz – Break Time (EP)

Falz, a well-known rapper has unwrapped the lyrics to his outstanding song “Church Mind,” featuring Priesst and Kurdi Klymax.

They make it easy to understand every line, learn the words, and sing along from beginning to end. If you are familiar with the effort and creativity these artists put into their music, you will enjoy reading these lyrics.

Church Mind Song Lyrics By Falz Ft. Priesst & Kurdi Klymax Below.

Baba dey Jaiye for lekki
Omo dey suffer for trenches
Bukata wey dey hold Omo for neck
This one na baba Ozempic
Sapa Olympics
Gbadura oluwa will fix it
Padi want secure him pocket alone
Ojukokoro turn am to pick me
Everybody get freedom of foolery
Brodaly abegi feel free
Zero Zero 1234 Take my AZA Oya credit am
At all at all na eem bad pass Shey na why dem
dey call am Abegistan
O ri quick bag o ti loose guard
He go kiss feet he go lick nyash
See shit for him mustache
Please keep your distance

Many tins wey
I no want try
Many tins wey
Shima want buy
I want go heaven
I no want die
Wickedness dey
Inside church mind

Oh my God what is this
Yahoo boy dey shout thief
Everybody dey collect
Cobhams gan dey see things
My baby say she want wig
She don dey gum body since
No fit tell her say I no guide
Now That kind thing dey kill steeze

As long as you dey alive
I swear to God you don die
Money can’t buy happiness
Wetin poverty go fit buy ?
Olopa conclude I be criminal
Shey na dada be person crime?
I no look like wetin I dey face
Omo Thank God say person fine

Ye leader of tomorrow see shege (shege)
Leaders of tomorrow still dey wait (wait)
Leaders of tomorrow don dey old o
Grandpapa dem still dey race

Be like the tomorrow don dey late
All of my padis dey relocate
Leaders of tomorrow don dey crase o
Wetin dey happen nau kileleyi kileleyi?

Many tins wey
I no want try
Many tins wey
Shima want buy
I want go heaven
I no want die
Wickedness dey
Inside church mind

People dey suffer but pastor dey tell us to
pray
They teach us to never complain
If you get problem don’t bother to tell
anybody
Say Jesus will show you the way
They talk say the dread wey I carry for head is
blocking my blessings
Yet
Politicians wey dey thief dey pay tithe and
offering
Call him a saint
Poverty capital we too dey suffer but we no
dey feel am
We feel say na norm
Police go stop you for dripping for Lagos
Dem fit to shoot your papa with a gun
I hear say EFCC don dey raid
I’m not a scammer but still I go run
This na the life I dey live for Nigeria
Yet nobody get mouth to talk say e wrong
Like bro what the fuxx? ahh

Get Song Here

 

 

 

Do you find Tunesloaded useful? Click here to give us five stars rating!

 

You May Like

Join the Discussion

2 Comments

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*

error: Content is protected !!